Hudson Odoi fit play for Ghana
Hudson Odoi fit play for Ghana
Chelsea FC star boy Callum Hudson Odoi wey don represent England for youth level don comot talk say him fit still switch and play for him papa land wey be Ghana.
FIFA rules demand say players fit become eligible switch play for another country only three years after their last appearance for the association wey dem wish to leave. Despite say the player don already get 3 caps for English senior team for 2019, him still dey eligible to switch play for Black Stars of Ghana before 2022 World Cup.
The 20-year-old nor too get playing time for Chelsea last season because of minor injuries and e be one of the things wey affect him form make England nor call am go Euros.
The champions league winner been visit Ghana last month and him meet President Nana Akufo-Addo who beg am say make him consider to play for Ghana. Him also get meeting with Ghana Football Association President Kurt Okraku and Ghana Sports
minister Mustapha Ussif.
The player come also yan journalists say him fit still change him mind play for the Ghanaian National team.
Reports carry am say the Ghana Football Association dey also pursue Chelsea academy product wey dey play for Brighton & Hove Albion Tariq Lamptey, Watford winger Kwadwo Baah and Eddie Nketiah wey dey play for Arsenal FC.
As the thing take happen like that, we hope say other players like Tammy Abraham and Fikayo Tomori wey don snub Naija to play for England go do U-turn before e too late for Dem. But the mata be say we even need them?




Comments
Post a Comment