Posts

Hudson Odoi fit play for Ghana

Image
  Hudson Odoi fit play for Ghana Chelsea FC star boy Callum Hudson Odoi wey don represent England for youth level don comot talk say him fit still switch and play for him papa land wey be Ghana.  FIFA rules demand say players fit become eligible switch play for another country only three years after their last appearance for the association wey dem wish to leave. Despite say the player don already get 3 caps for English senior team for 2019, him still dey eligible to switch play for Black Stars of Ghana before 2022 World Cup.  The 20-year-old nor too get playing time for Chelsea last season because of minor injuries and e be one of the things wey affect him form make England nor call am go Euros.  The champions league winner been visit Ghana last month and him meet President Nana Akufo-Addo who beg am say make him consider to play for Ghana. Him also get meeting with Ghana Football Association President Kurt Okraku and Ghana Sports minister Mustapha Ussif. The player...

Messi No Dey Go Anywhere Oh!

Image
  E Be Like Say Messi No Dey Go Anywhere Oh!  According to transfer guru Fabrizio Romano, Oga Leonel Messi no dey go another club. The obonge player wey just pake Copa America for him contri Argentina afta long suffer head go sign anotha deal wey go see am still remain for Barcelona.  The report say Messi and the Catalan club don reach agreement til 2023 but him go sign another 5 years contract. Dem follow talk about him salary mata and how dem go take dey pay am for long run.  The report follow talk say Messi new contract go run reach June 2026 and dem go take include money €600m clause ontop him head. Omo! see money.    As Barcelona and Messi don agree so, na just time remain make dem announce am.  I still dey wait to hear weytin those people wey dey ask Messi to comot for Barcelona go prove himsef for anoda league go talk oh 🤣🤣🤣

Arsenal FC Update

Image
One of English Premiere League top clubs, Arsenal wey been get kukere progress for plenty seasons dey try their best to reenforce and buy beta beta players wey go fit ginger them qualify for Champions League next season or even contend for the league title with other obonge EPL clubs like European Champions, Chelsea, Manchester City, Liverpool and Manchester United.  The Gunners don sign Benfica defender Nuno Tavares and him add quality to their squad  as their top defender Granit Xhaka fit comot for the club go AS Roma of Italy. Arsenal dey very lucky because the young player Sabi run well well and him sabi shot ball with him right leg despite say him be feetie.  The new signing tell Arsenal website say "Wen I finish the season my agent tell me say Arsenal dey interested in me. At first the news sweet my belle. As i  reason the mata I come discuss am with my Mama. I been  dey very happy and now wey I don finally move, I dey very happy."  him also talk say ...

"We no dey fear England" - Leonardo Bonucci

Image
  That confirm Italian player defender wey all of us know as Leonardo Bonucci don beat him chest say him and his team mate no dey fear to face the Three Lions of England for the front of their home supporters and backyard wey be Wembley Stadium.  "We go play for their yard but we no go fear that one. We dey eager to go Wembley on Sunday. Even though most of the people go be English supporters." The obonge footballer tell the Evening Standard.  "Going there be big ginger to us. We go try achieve something historical and we try do our best to play beta match, then we go see weytin the result go be."  Many people also believe say Leonardo Bonucci and him team mate captain Georgio Chiellin be the backbone of the Italian national team and e go hard England wey never enter major final for 55years to beat them easily.  The Azzurri don dey unbeaten for their last 33 international matches under their coachie Roberto Mancini wey be former Man City coachella. Them go meet ...

Naija Keeper Don Sign for Arsenal

Image
Naija Goalkeeper Arthur Okonkwo don officially sign long term deal with Arsenal. This one mean say the 19 year old player don dey part of the first team squad as him don dey train and travel with them. Okonkwo don dey eye him first senior match with the senior team for the near future as na him be the third choice now and him fit get feature for the pre-season matches.  The Naija boy don climb the academy ladder from under 18 to under 23 were him be regular and him don impress the coaches and board well well. Arthur Okonkwo go wear the #33 jersey wear legendary keeper Petr Cech been wear before.  Photo by Stuart MacFarlane/Arsenal FC via Getty Images As the obonge young goalie don commit him future for the north London club we wish am all the best and we hope say him go be like him African brother Edouard Mendy wey don impress and dey do signs and wonders for Arsenal London rivals Chelsea. 

5 Facts about Tiago Alcântara

Image
  5 thing wey you nor know about Spanish and Liverpool futball club midfielder Thiago Alcântara do Nascimento  1. Dem born the obonge footballer on for 11 April 1991 for San Pietro Vernotico , Italy.  2. Tiago Alcantara na Brazilian but him dey play for Spanish National Team.  Tiago Alcântara playing for Spanish National Team 3. Him papa na legendary Brazilian footballer. The man name be Mazinho and him win U.S.A 1994 FIFA World Cup, 1989 Copa America,  Copa America runner for 1991 and 1988 Olympic silver medal for Seoul. The man also win plenty championships with him clubs and him also get plenty personal awards like South American player of the year for 1998 and Brazilian Silver Ball award in 1987 and 1988. Mazinho and his sons, Tiago and Rafinha 4. Him younger brother na him be Rafinha wey dey play for PSG and Brazil National Team.  Rafinha playing for PSG 5. Him mama na former professional volleyball player. No wonder, sport dey run for dem children b...

Players Wey Don Move for inside the Transfer Window so far

Image
Since the Transfer Window open for obodo oyinbo, clubs don dey busy with biznes. While some don start to dey buy to improve their team, others dey make money by selling their player and others dey send their players go loan for other clubs. Our team don gada 30 confirm players wey don move. Achraf Hakimi - Inter Milano to Paris Saint-Germain for £60m + add ons Fikayo Tomori - Chelsea to AC Milano - €28.5 (5years) Jadon Sancho - Burrussia Dortmund to Manchester United for €85m Gigi Bufon - PSG to Parma - Free agent Memphis Depay - to Barcelona (3years) - Free agent. Sergio Ramos - Real Madrid to Paris Saint-Germain - Free agent David Alaba - Beryern Munich to Real Madrid - Free agent Alvaro Morata - Atlético Madrid to Juventus (loan extension until June 2022) - €20m Hakan Çalhanoglu - AC Milan to Inter Milan Boubakary Soumaré - Lille to Leicester City for €23m Nico Gonzalez - Stuttgard to Fiorentina for €27m +add ons Georginio Wijnaldum - Liverpo...