"We no dey fear England" - Leonardo Bonucci

 


That confirm Italian player defender wey all of us know as Leonardo Bonucci don beat him chest say him and his team mate no dey fear to face the Three Lions of England for the front of their home supporters and backyard wey be Wembley Stadium. 


"We go play for their yard but we no go fear that one. We dey eager to go Wembley on Sunday. Even though most of the people go be English supporters." The obonge footballer tell the Evening Standard. 


"Going there be big ginger to us. We go try achieve something historical and we try do our best to play beta match, then we go see weytin the result go be." 


Many people also believe say Leonardo Bonucci and him team mate captain Georgio Chiellin be the backbone of the Italian national team and e go hard England wey never enter major final for 55years to beat them easily. 



The Azzurri don dey unbeaten for their last 33 international matches under their coachie Roberto Mancini wey be former Man City coachella. Them go meet England for the final after them knack Spain comot for the semi final. 


After all this making of mouth wey Oga Leo don do, we hope say England no go come beat the Azzurri tomorrow like how Spain take disgrace them for 2012 final as them panel beat them 4-0. 


Comments