Messi No Dey Go Anywhere Oh!

 E Be Like Say Messi No Dey Go Anywhere Oh! 


According to transfer guru


Fabrizio Romano, Oga Leonel Messi no dey go another club. The obonge player wey just pake Copa America for him contri Argentina afta long suffer head go sign anotha deal wey go see am still remain for Barcelona. 


The report say Messi and the Catalan club don reach agreement til 2023 but him go sign another 5 years contract. Dem follow talk about him salary mata and how dem go take dey pay am for long run. 


The report follow talk say Messi new contract go run reach June 2026 and dem go take include money €600m clause ontop him head. Omo! see money.   


As Barcelona and Messi don agree so, na just time remain make dem announce am. 


I still dey wait to hear weytin those people wey dey ask Messi to comot for Barcelona go prove himsef for anoda league go talk oh 🤣🤣🤣


Comments