Arsenal FC Update
One of English Premiere League top clubs, Arsenal wey been get kukere progress for plenty seasons dey try their best to reenforce and buy beta beta players wey go fit ginger them qualify for Champions League next season or even contend for the league title with other obonge EPL clubs like European Champions, Chelsea, Manchester City, Liverpool and Manchester United.
The Gunners don sign Benfica defender Nuno Tavares and him add quality to their squad as their top defender Granit Xhaka fit comot for the club go AS Roma of Italy. Arsenal dey very lucky because the young player Sabi run well well and him sabi shot ball with him right leg despite say him be feetie.
The new signing tell Arsenal website say "Wen I finish the season my agent tell me say Arsenal dey interested in me. At first the news sweet my belle. As i reason the mata I come discuss am with my Mama. I been dey very happy and now wey I don finally move, I dey very happy."
him also talk say "Coacie Mikel (Arteta) and Edu help me plenty. Dem been dey call me everytime and dem make me feel say the club really need me. I like am like that because e really ginger me and I dey very grateful to them."
The Gunners dey also eye Lyon star Houssem Aouar. Market square tori be say the club go also like sign in Barcelona players and Samuel Umtiti and also Ajax goalkeeper Andre Onana so that make them help solve their defense wahala.
As time no too dey wey hope say dem go fit sign more players before transfer window close.



Comments
Post a Comment