Naija Keeper Don Sign for Arsenal

Naija Goalkeeper Arthur Okonkwo don officially sign long term deal with Arsenal. This one mean say the 19 year old player don dey part of the first team squad as him don dey train and travel with them.


Okonkwo don dey eye him first senior match with the senior team for the near future as na him be the third choice now and him fit get feature for the pre-season matches. 


The Naija boy don climb the academy ladder from under 18 to under 23 were him be regular and him don impress the coaches and board well well. Arthur Okonkwo go wear the #33 jersey wear legendary keeper Petr Cech been wear before. 

Photo by Stuart MacFarlane/Arsenal FC via Getty Images


As the obonge young goalie don commit him future for the north London club we wish am all the best and we hope say him go be like him African brother Edouard Mendy wey don impress and dey do signs and wonders for Arsenal London rivals Chelsea. 

Comments